Monday 19 October 2015

John Legend's Wife,Chrissy Teigen Don Talk Say She No Dey Get Twins


Chrissy Teigen don deny the rumour wey peopl dey talk say she and her husband dey expect twins after when commenters suggest say the model's baby bump dey too big for just one child.

Una don hear am,una wey dey carry rumour!

Nollywood Veteran Actor,Zack Orji Don Talk Say Him Be Pastor Since 3 Years


This our Naija actor,Zack Orji wey don act over hundreds of movie talk for one interview with City People say him don become reverend since 2013.

Him talk say him be ordained reverend and pastor so him dey get invitation to minister for different churches both within and outside naija,him say even him currently get angagement for South Africa this October.

As him dey talk why him decide to be a pastor,him talk say him no ready to become reverend,na him Bishop wey God probably inspire am to ordain am.

Him Say him dey worship with Power Line Bible Church wey dey under Bishop Lawrence Osagie,and him ordain am in 2012.Him talk say even before them ordain am him bin dey receive invitations from different places to come minister,so when the offer come from him bishop to ordain am him no reject the offer.Him take the offer with him whole heart and him come dey happy as him come get opportunity to talk with people,inspire them and draw them closer to God.

This one na better thing bross! God go strengthen u in ur ministry!!!

Appeal Court Don Adjourn The Judgement On Saraki's Case


On Monday,them shift The Appeal  by senate president Bukola Saraki against the jurisdiction of the Code of Conduct Bureau  (CCB) to try him over alleged false declaration of asset to indefinately by court of appeal wey they sit for Abuja.

Commedian,Eddie Murphy Don Return On Stage After 28 Years,Him Come Slam Bill Cosby


Eddie Murphy don come back on stage after almost 28 years and Bill Cocby be one of him target while him be dey receive the Mark Twain Prize for American Humor for Kennedy Centre in October 18.

Him call the prize a 'tremendous honour' but him no wait to add warning to Cosby.

Man Crush Monday: Uti Nwachukwu Be Their Guest


Today's Man Crush Monday na nollywood actor Uti Nwachukwu.

The 33years old celebrity come from Delta state,Uti start to dey become popular when him be contestant for Big Brother Africa in 2008,as we know he come win the show in 2010 when they recall am.

Uti Nwachukwu get Bsc in computer science an education from Benson Idahosa University.THey regard Uti as one of the top nollywood and one of Naija most desirable celebrities.

Apart from acting,him be th host of MNET show "Jara".Last year him be the host of "Star The Winner Is"

Because of him achievement in the entertainment industry,his alma mata award am in Appreciation an Recognition of him role in Advancing the Entertainment Industry.

E get one time wey people bin dey carry rumour say Uti bin dey date one upcoming singer,Saeon.Abeg no me talk o! na wetin people talk o!

Veteran Rapper,Eedris Abdulkareem Don Accuse Buhari Of Killing Fela Anikulapo Kuti


The former Remedies rapper go on stage for the ongoing felabration to accuse the president of killing the founder of afrobeat Fela Kuti.

Them arrest Fela plenty times under various military regimes.Them sentences Fela for 5years in prision under the then Buhari regime for currency smuggling in 1986 something wey several right groups like Amnesty international consider as political motivation.

Fela come get him freedom two years later when Gen Ibrahim Babangida come take over power from Buhari.

Reporters talk say Seun Kuti one of Fela sons show dissatisfaction when Buhari come back as democratic president.

Blogger,Linda Ikeji Talk Say She Never Sleep With Any Man For Money


This pretty blogger write on her blog say her name na Linda Ikeji,she be blogger,she be 35years old and she never sleep with any man because of money and not only say she never sleep with any man,she never even consider the thing for her mind....and see her now with her house wey cost her half a billion naira.

She come say make una listen,you dey beautiful and even strong pass the way u know sef.She say nothing dey wey u no fit achieve if u put your mind to do am.Uptill 5years ago she be struggle entrepreneur,she no fit count how many offices for Lagos she don sit down for hours where she dey wait to see people wey fit support her business........but most times she no dey even pass the reception area.But she no give up and stop believing,now see her today where she dey.

She talk say you too fit do pass this one,no dream dey to big and no dream dey too small,no mountain dey too high,all dey your mind.E dey up to you if you elieve in yourself and in your God who dey guide u,the sky na just yout starting point.

She say make una stop to dey wait for men to give to you...to give you clothe and food.She say she promise you u can do it for yourself,e creative and start working....make you know say your dreams dey valid..and nobody fit make your dreams come true except you.

Find somthing wey u dey good at and you get passion for.Work hard towards that thing wey you like and make you dey consistent,patient,start young even if you no dey young,e never dey too late!

No be lie!!! na true talk!!!