Monday 19 October 2015

Blogger,Linda Ikeji Talk Say She Never Sleep With Any Man For Money


This pretty blogger write on her blog say her name na Linda Ikeji,she be blogger,she be 35years old and she never sleep with any man because of money and not only say she never sleep with any man,she never even consider the thing for her mind....and see her now with her house wey cost her half a billion naira.

She come say make una listen,you dey beautiful and even strong pass the way u know sef.She say nothing dey wey u no fit achieve if u put your mind to do am.Uptill 5years ago she be struggle entrepreneur,she no fit count how many offices for Lagos she don sit down for hours where she dey wait to see people wey fit support her business........but most times she no dey even pass the reception area.But she no give up and stop believing,now see her today where she dey.

She talk say you too fit do pass this one,no dream dey to big and no dream dey too small,no mountain dey too high,all dey your mind.E dey up to you if you elieve in yourself and in your God who dey guide u,the sky na just yout starting point.

She say make una stop to dey wait for men to give to you...to give you clothe and food.She say she promise you u can do it for yourself,e creative and start working....make you know say your dreams dey valid..and nobody fit make your dreams come true except you.

Find somthing wey u dey good at and you get passion for.Work hard towards that thing wey you like and make you dey consistent,patient,start young even if you no dey young,e never dey too late!

No be lie!!! na true talk!!!  

No comments:

Post a Comment